What time be Nigeria vs South Africa match?
Di kick off time for di Olympic qualifying match between Nine-time African champions Nigeria and reigning African champions South Africa na 5pm West Africa Time on Friday.
Na for Pretoria Loftus Versfeld arena di second leg go take place on Tuesday next week.
Nigeria vs South Africa prediction
''Dis match go dey difficult for Nigeria''. Na wetin football sabi pesin Fisayo Dairo tell BBC Pidgin.
‘Di build up to di game get as e be, sake of players withdrawal and late arrivals’’.
‘’No be against team like South Africa wey you go prepare like dat’’. Dairo add.
Prediction: 1-1.
Joshua Adetunji say: Dis two-leg tie go tough well-well onto say Nigerian Super Falcons wan return to di Olympics afta 16-years, while Banyana Banyana dey look to qualify afta dem miss out on di last edition for Tokyo.
Prediction: 2-1
Where to watch Nigeria vs South Africa
For now Nigeria football federation neva tok weda di match go dey live for television.
But di oda Super Falcons Olympic qualifying match bin dey live for NFF YouTube channel.
Nigeria vs South Africa team news
Super Falcons defender Ashleigh Plumptre go miss dis match sake of injury.
Jumoke Alani go take her place for di team.
Nigeria neva take part for di Women Olympic Football tournament since 2008, wen dem bin lose all three matches for di group phase for China.
Captain Rasheedat Ajibade tell tori pipo on Wednesday say:
“From di time wey we play Ethiopia, wey bin ginger to see dis qualification series through. Our plan na to win di slot for di Olympics. Most of us neva play for Olympics, na big issue wit us. We wan go Paris.
“We get some issues wey we need to sort out with Banyana Banyana, really. But, dat no be di motivation dis time. Di motivation na to qualify for di Olympics.”
Di African female footballer of di year Asisat Oshoala go join her teammates on Thursday.
Nigeria players wey dey Camp as at Wednesday:
Goalkeepers: Chiamaka Nnadozie, Tochukwu Oluehi, Linda Jiwuaku
Defenders: Jumoke Alani, Osinachi Ohale, Chidinma Okeke, Shukurat Oladipo, Michelle Alozie, Nicole Payne
Midfielders: Rasheedat Ajibade, Toni Payne, Deborah Abiodun, Jennifer Echegini, Christy Ucheibe, Halimatu Ayinde
Forwards: Uchenna Kanu, Gift Monday, Omorinsola Babajide, Ifeoma Onumonu, Esther Okoronkwo, Chiwendu Ihezuo
South Africa team news
Goalkeepers: Kaylin Swart, Katlego Moletsane, Regirl Ngobeni
Defenders:Karabo Dhlamini, Fikile Magama, Tiisetso Makhubela, Lonathemba Mhlongo, Bambanani Mbane, Noko Matlou, Lebohang Ramalepe, Bongeka Gamede
Midfielders: Linda Motlhalo, Refiloe Jane, Sibulee Holweni, Sinoxolo Cesane, Nomvula Kgoale, Nonhlanhla Mthandi, Amogelang Motau
Forwards: Gabriela Salgado, Jermaine Seoposenwe, Noxolo Cesane, Hilda Magaia, Themba Kgatlana, Nthabiseng Majiya